Tuesday, November 24, 2015

TEETH FALL APART WITH MC TWENTY2 NA DIS SUNDAY, 29TH

Jemilola Williams wey every body sabi as Mc Twenty2 don ready to host the full ibadan city dis Sunday as he dey arrange him gospel comedy show wey he call Teeth Fall Apart. The show wey go feature plenty Ibadan comedians go shele for Glad Tidings Assembly wey dey No 7 Aina Street, Ring Road, Ibadan and na 1pm dem go start the red carpet. Some of the pipu wey go dey there na Mc Solid, Babatunmise, Arole, Afouda, Dr. Frick, Rapindaddy, Asiri, Mc Clement, Solafunmi, Anointed Mallam, Remote, Cris da lectura, Ambassador plus plenty other pipu. Na free show o, so make una no dull am.

No comments: