We former Presido Olusegun Obasanjo nos how face yesterday
for where we presido Goodluck Jonathan for dey talk him mind yesterday say him wan run again for the 2015 presidential
election for Abuja on Tuesday. Another person wey no show face na former
military boss, Gen. Ibrahim Babangida. And 2 of dem na PDP member o. Babangida too
bin wan run in 2011, but him loose to Bro Jona. Obasanjo too na former chairman
of dem Board of Trustees for the partybefore he later resign him position on top
some over disagreements with the way him say dem dey run the party.
Many pipu dey reason as say e be like say Baba Iyabo no
support the plan of Uncle Jona to go again for the second term because say
presido bin agree with dem Oga for party, plus dem governors in 2011, say na
only once him go run.

No comments:
Post a Comment