Friday, September 11, 2015
NAIJA GOVERNORS HALLA SAY DEM NO GREE MAKE WE DEY KILL CORRUPT PIPU O
I dey laff o....dem say we Governors for Naija don dey halla, dey shine eye say na lie dem no gree o. Dem say if na play for Naija o make we stop am o, cos dem no gree make we dey kill anybody wey dem catch say he chop community money. Dem say na make we dey send dem go die for prison na him make brain pass. Dem say even if that kain tin work for dem for Ghana that year wen Rawlings bin dey there, but e no go fit work for us for Naija. The Governors wey yarn na from Ogun, Jos, Ekiti plus Rivers State. But Governors for Ondo and Nassarawa say no shaking, if Naija pipu gree dem no dey shake.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment