Wednesday, November 12, 2014

BROS YOU DEY FALL OUR HAND, NAIJA PARA FOR UNITED STATES




Tori say we Naija don dey para for United States o, as per say dem dey fall our hand on top dis Boko Haram mata, as dem no dey allow us buy better weapon to take fight the badt guys, na so Empowered Newswire yarn the tori.
 

When he dey hail one delegation of the U.S. Council on Foreign Relations yesterday, Naija Ambassador to the United States, Professor Ade Adefuye talk am come out say we Naija pipu and we government feel say America don fall our hand. He even yarn dem say the thing dey shock all of us o, say as dem get power reach and get better military technology, Boko Haram still dey knack us for ground and dey show dem muscle. He say come reach now, U.S. Government still dey refuse to sell for us better equipment wey we go take finish dem boko boys sharperly, but na so so excuse dem dey give say our military dey violate human rights. But sha o, Mr. Adefuye clear dem doubt for that meeting o say that gist na lie o say if dem no know before make dem know now o say make Naija stand well well na him go fit pay America o.

No comments: