Friday, July 15, 2016

NA BABA GOD NAIM DEY SAVE ME OOO....LOLA OMOTAYO OKOYE

Miss Simplicity - Lola Omotayo Okoye wey be d wife of ogbonge singer Peter Okoye kawasaka enta her IG page sey make pipu o make dem dey pray for world peace as e be like sey nowhere save again base on d tori come out yestaday sey sum pipu kpain for Nice wey dey France, na so one of her fans wey no fit keep e mouth for one place com tok sey Lola dey save bcos of her husband o bt trust Yorubas naw, we no dey like go house go collect reply, na sharperly naim Lola answer ham sey na Baba God naim be Oga wey dey keep her safe o nd she tell d fans sey her husband o no be god..
Confirmento, I dey like all dis kind answer, u no need insult d fans, d reply na polite way to take tell d fans sey make e shut up...ma'am Lola abeg u too much...
See how d tin go on top instagram afta d cut....

No comments: