Miss Simplicity - Monalisa Chinda wey be correct ogbonge actress naim don sama us wit pinshures wey e be sey she nd her swaggalicious pikin take o nd dem two make sense die for d pinshures like tomorrow no dey o..
Yes o my very Monalisa no dey carry last nd her pikin sef don dey try tell pipu sey she sef no go carry last o...
Like one of my boss go tok ham, he sey I dey crush d woman, me I no argue wit ham o, na who no go like appreciate beautiful person wey Baba God create??? Me I love dis woman to d bones oo
Make una see hw she nd her pikin fine for d pinshures afta d cut oo...
Saturday, July 16, 2016
(FOTO)MONALISA ND HER PIKIN GET SWAG NO BE SMALL
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment