Miss Simplicity - The tori wey dey nack our door naw naim dey tok sey Mercy Aigbe-Gentry don join pipu like Femi Adebayo, Muyiwa Ademola, Yul Edoche, Toyin Aimakhu nd many like dat wey get Film Schools o, dat is to sey Mercy sef don get her own film school o nd she don launch ham o..
On top d mata, Mercy tok sey d school wey the name be "The Mag School of Drama na her own way of giving sumtin back to the society o..She tok sey the school go dey train pipu for 4 months on top acting, script-writing, movie nd plenty plenty tins like dat o nd sey she o go help pipu build solid foundation nd help dem develop their skills o..
Last last she com thank Baba God nd her fans wey dey kampe for her back..
Na so, correct news...ma'am Mercy we for TPN dey tok sey congratulobia oooo nd we dey pray sey make Baba God o make He dey bless u wella o...
Saturday, July 16, 2016
MERCY AIGBE DON OPEN FILM SCHOOL OOOO
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment