The Lagos State government nahin don announce one collabo with Google sake of say dem wan provide digital skills training give 50,000 students for Lasgidi tertiary institutions. The special adviser ontop education mata Mr Obafela Bank-Olemoh yan dis colabo for hin office, E con dey yan say the training na three-month plus say e go dey for students of Lagos State University (LASU), Lagos State Polytechnic (LASPOTECH), Ikorodu; Michael Otedola College of Primary Education (MOCPED), Epe; Adeniran Ogunsanya College of Education (AOCOED), Ijanikin; plus the Lagos State College of Health Sciences, and other interested members of the public dem. Mr Obafela yan say dis wan nahin dem du sake of sah dem wan position students to function for 21st Century plus say digital skills dey very important. E con yan say Hin sabi say if Lagosians get chance plus skills to compete, dem go do wonderful things. Bank-Olemoh con still add say the students wey perform wella for the training nahin Google go choose as den trainers and say na dem go help the communication company to implement future training programmes. Country Manager for Google, Mrs Juliet Ehimuan-Chiazor yan say the training enta at the right time because say na now the potential of the Internet dey to generate income. Dem con yan say e day very important make tertiary institutions incorporate digital training into dem curriculum because say na Everybody need digital skills.
No comments:
Post a Comment