Wednesday, June 1, 2016

SHUU... FEDERAL GOVERNMENT SAY MAKE DEM CATCH SOME BEFORE BEFORE MINISTERS PLUS GOVS, FOR WETIN?

Because say some before before government pipu no gree return  diplomatic passports plus other official documents, the federal government don order say make dem begin arrest dem. The officials include former governors, lawmakers plus others wey serve during the last term of President Goodluck Jonathan. Government don since last year na hin ordered say all before before officials say make dem submit all the documents to the Nigeria Immigration Service, NIS, plus  threat say dem go use sanctions on those who no gree return. Dis one nko nahin make the new Comptroller General of the Nigeria Immigration Service, Muhammad Babandede, for hin first briefing with top management staff of Nigeria Immigration Service yesterday for inside Abuja, yan say make den arrest  all the before before  political office holders wey no gree return their diplomatic passports.

No comments: