We tear rubber captain for Super Eagles, Mikel Obi, don dey beg all Naija pipu make dem support dem against Pharaohs of Egypt for the Gabon 2017 AFCON qualifying wey dem wan play. Tori yarn us say dem don dey train wella for the Ahmadu Bello Stadium (ABS) yesterday and e be like say dem don ready to scatter the Egyptians. Mikel, wey dem just show him face to the press for one kain media show for Ahmadu Bello Stadium, Kaduna, promise say he go do beta for the team, day Make we calm down dem go finish Egypt today. Make we no forget say Mikel get levels wella for the team since he first play in 2006, but coach, Sunday Oliseh, no look him side when he bin dey find captain, come go choose Ahmed Musa take replace Vincent Enyeama. For the media meeting, Ahmed Musa say he gats give Mikel the captain back cos Mikel senior a for the team.
No comments:
Post a Comment