Saturday, June 4, 2016

TEEBILLZ DON DEY MOVE ON WIT HIM LIFE JARE


Miss Simplicity - E wan be like sey Tunji Balogun wey we knw as Teebillz don put d mata wey shele between him nd him wife for five weeks now behind him back o... One correct source naim dey tell Express NG sey dem see Teebillz for one popular bar wey dey Lekki Phrase 1 (Churchill Bar) wit one of him frd dis week and sey d guy no be like person wey get any worry for mind o nd he no be like who no well as him clean for d black long-sleeved Kaftan wey him wear com d bar o. 


D source tok sey Teebillz grit pipu wey him knw wen he enter d bar o nd him Sidon for d main bar small before he com go inside d VIP area nd he enjoy himself wella dia oooo. Even tho Teebiilz neva make major public appearance, d source tok sey d Teebillz wey e see be like person wey carry d issue comot for mind o... Na so e suppose be naw, since dem don do test nd him no get any drug issue....abeg o oga Teebillz we dey wait make u come out for public oooo..

No comments: