Tuesday, May 31, 2016

IPOB PLUS MASSOB MEMBERS DO ACTION FILM GIVE WE NAIJA ARMY

The Nigerian Army, yesterday, yan say the attack wey members of the Movement for the Actualization of Sovereign State of Biafra, MASSOB, for Onitsha, Anambra State do for security agents plus including military personnel so nahin no make sense at all. Dem yan dis one for one gist by  colonel H. A GAMBO, wey be the Deputy Director Army Public Relati‎on of the 82 Division, Nigerian Army, yan say many many soldiers dem folow injure for the gbege
The attack so nahin dem tok say dem one take mark one year of APC plus Presido admin for office. Tori show say as tension begin grow nahin make security agencies of we Nigerian Navy, Nigeria Police, Department of State Service, plus National Drug Law Enforcement Agency enta the film say make den prirect pipu life as say dat wan too dey part of tmdem duty. As security agencies show dace nko nahin the MASSOB/IPOB members wey don already gather for one school location for Ataa Road near Saint Edmunds' Catholic Parish Maryland Nkpor-Agu for Anambra State begin attack th security agencies dem.

No comments: