RIVERS State Governor, Chief Nyesom Wike, on Monday don Loud wetin he follow President Muhammadu Buhari yarn for the Presidential Villa for Abuja. Wike say he yarn Presido say hin government go gbege cultism plus insecurity for the 4 local government area wey dey the state. President Buhari on May 16, 2016 na him follow Wike enter meeting wey dem close door do with Rivers State governor. Since den nobody hear wetin dem yarn for the meeting. Na him make Wike yarn for Port Harcourt for one kain town hall meeting wey dem call, "Accounting for Governor Nyesom Wike's Administration: One Year After," he say na different things den din dey do to gbege security palava for dem State. Wike say wetin he yarn Presido be say him government go gbege insecurity for Abua/Odual, Ahoada-East, Ahoada-West plus Ogba/Egbema/Ndoni local government areas.
No comments:
Post a Comment