Nawa O, as military pipu plenty reach for places where dem for dey do oil for Niger Delta, the Niger Delta Avengers (NDA) early mom today, Wednesday don blow oil wells wey belong to Chevron.
To come put salt for the injury, dem come climb on top Twitter go take our military do yeye, dem say with 100 Gunboats, 4 Warships plus Jet Bombers NDA don blow Chevron Oil Well, wey be RMP 23 and RMP 24 by 3:44am dis Morning, dem come even say the Wells wey dem bomb, RMP 23 and RMP 24 na him dey produce oil pass for Chevron.
No comments:
Post a Comment