Saturday, June 4, 2016

SEE WETIN KEMI AFOLABI TOK ABT D FILM WEY SHE WAN TAKE NACK OUR DOOR SOON O

Miss Simplicity - Kemi Afolabi wey be one of d best actress wey Yoruba Nollywood get naim don ready to sama us wit one film wey e be sey na one women go dey o...
For one interview Kemi tok sey d film name na "Modorisa" nd na abt our culture wey many pipu especially we small pikin no dey proud of today..
Kemi tok sey M'odorisa na abt one woman wey dem make king wey come dey live life according to one oyinbo adage wey tok sey "what a man can do, a woman can do better' o. She tok sey d film get many many lesson wey pipu fit learn base on sey she dey use d film take dey teach pipu sey make dem value their culture o, make dem no look down on demselves nd make dem no dey shame to tell pipu their true identity oooo.
Kemi tok sey she plan to cast 1000 women for d film o so she dey call pipu wey get mind to act film make dem come out com join dis film as d tin go hot well well o...
So my countri pipu make una come out o, bt dat na if u be lady nd if u like to act oooo..

No comments: