Miss Simplicity - Omotola Jalade wey we knw as Omosexy wey be confirm actress for naija bin tell her IG fans sey make dem ask her any question wey dem want o nd sey she go ansa ham well. Trust ladies naw, one of dem com ask sey she wan knw d kind cream wey our actress dey use wey dey make her body shine o, na so Omotola com ansa sey na coconut oil, baby lotion naim she dey use nd sey she dey drink plenty water o.
Omosexy sey her secrete na Baby Lotion, Coconut oil nd water oooo...
Hmmm really??? I don dey hear d beta work wey baby lotion dey do for bodi bt I neva put mind before sha, so d tin make sense?? Bt my pipu make una no reason ham o, as Omosexy don tok ham so, many ladies go wan dey use ham o nd make I no lie una coconut oil nd baby lotion go com cost o bcos d tin go dey for hot demand naw...lolzzz
Make una see Omosexy nd her fans chat afta d cut...

No comments:
Post a Comment