Wednesday, June 1, 2016

SEE LEVELS... GOVERNOR WIKE POLONGO JOSEPH YOBO AS ONE OF HIM SENIOR SPECIAL ADVICERS

SEE levels O. Oga Governor for Rivers State Nyesom Ezenwo Wike don make Super Eagles Captain before , Joseph Yobo him  Senior Special Assistant on top Sports Development for Rivers State. One statement wey dem throway by Simeon Nwakaudu, Special Assistant to Rivers State Governor on top Electronic Media na him polongo the mata come add say na sharperly and instanta he dey start work O. Wow.... SEE levels upon levels for Bros, na recently dem still make him and him wife chief for one village like dat O. We for TPN say congratulobia to we captain fantastic.

No comments: