Monday, June 13, 2016

SHUU... NAIJA ARMY DON START COLLABO WITH LOCAL HUNTERS ONTOP WETIN?

The GOC of 7 Division of the Nigerian Army, Brig General Victor Ezugwu, don dey yan say make beta beta colabo dey between we army plus the local hunters sake of say na dem sabi as everything dey go for North East. E yan say the local hunters dem nahin sabi how weather take be for the tamak plus as den fit take style enta sambisa. The counter insurgency war code named "Operation Lafiya Dole" nahin don enta wahala since rain don start because some places dey wey be say we army no go fit enta.
He con yan say the Division go provide the local hunters with cartridges for say den support we army for the war.

No comments: