Miss Simplicity - Moji Olaiya wey be d pikin of ogbonge highlife singer Victor Olaiya na one actress wey dey act for both Yoruba nd English movie nd d first time wey she go show face for television dat time na wen she act Ireti for Wale Adenuga Super story series wey e name be "No Pain, No Gain" before she come do one Yoruba film wey Dimeji Ijaduade do wey d name be "Sunmibare.... Dat Moji naim don ready to sama us wit anoda film wey she call d name "Iya Okomi" o. D premiere of d film go shele for Classique Event Place Ikeja, Lagos on July 31 dis yr, na Baba Tee nd Lepacious Bose naim go host d premiere nd na plenty plenty ogbonge actor nd actress naim go tanda for d Yoruba film wey mean "My Mother-in-law" for English o. Pipu like Foluke Daramola, Funsho Adeolu, Madam Saje, Mide Funmi Martins, Olaiya, Ronke Oshodi Oke nd many more. Na for lagos naim dem shoot d film nd d tori wey dey reach our hand be sey e be like sey our very ogbonge singer Victor Olaiya go perform for dia dat day nd d film sef go make sense according to d tori wey dey reach our hand, so make wey dey wait... See d film poster afta d cut...


No comments:
Post a Comment