Miss Simplicity - As many pipu dey cry sey Mohammed Ali don kpai, na so Bollywood actors nd actress sef dey cry sef for public o base on sey e get many of their old film wey e be sey na Mohammed Ali naim influence ham o, films like 'Saala Khadoos" nd to sey d tin go d way Prakash Mehraji plan ham Mohammed Ali for do film wit Amitabh Bachchan.... Now Amitabh himself don com out com yarn abt Mohammed o, he tok sey him first visit Mohammed for him house wey dey for Beverly Hills, Los Angeles for 1976 wen dem two bin wan do film togeda nd sey d man dey simple, he dey always smile nd he dey down to earth o. He tok sey tho dem no do d film again bt d time wey him spend wit Ali na d greatest time for him life nd sey Mohammed no only dey fight for ring o, sey he fight oda war nd obstacle for real life too o.
Amitabh Bachchan wey we knw as Mard naim com still tok sey as Mohammed Ali fight d wars reach, na him win o base on sey him life na unique one one o, even wen he face d tin wey we dey call racial discrimination, d man no give up o, he still dey motivate pipu wit him many thinking o nd even pipu today dey get inspiration from Mohammed Ali thinking... Amitabh come end him yarnings sey him dey sad as him lost him friend o nd sey " Unki Aatma Ko Shanti" dat is to sey " May his soul rest in peace...See Amitabh nd Mohammed Ali old pinshures afta d cut...

Hmmm see beta yarn, na true wey bible sey d day wey person die beta pas d day wey dem born ham base on sey na wen u die naim pipu go knw d real u bcos pipu go either tok gud abt u abi bad abt u... Abeg she Mohammed Ali mama nd him papa knw d kind life wey him go live wen him big??? Make we dey do gud oooo.

No comments:
Post a Comment