Wednesday, June 8, 2016

O BOY EH!... NA DUBAI HONEY-MOON THINGS FOR RONKE GIWA ONAFUWA

Shebi first of all na introduction, na afta dat one, engagement dey follow, come follow by traditional, white wedding go come follow for back. Afta dem nko? Na honey moon things na.... NA so e be for Radio girl, RONNY G, wey turn Mrs Onafuwa last weekend afta she say I do give her man, Mr. Bajo Onafuwa for Lasgidi. If you dey follow well, you go see say you no dey hear her voice for Radio, sake of say she go do the main...the main. And base in who she be, na for United Arab Emirates, Dubai she and her man go relax dem head plus some other things wey no concern us. Na she take style yarn us today for her Facebook page when she dey still try do some promotion business for one side, but she come put hashtag wey she take hunt us. #TheOnafuwastakeDubai. RONNY GO flex jare, you deserve am. Oga softly softly O, na we first get am before you come carry her O..... Lol.

No comments: