The Nasarawa State Police Command don show face 15 suspects wey the Police say dem catch ontop different different crimes including car snatching. The state Commissioner of Police, Mr. Lawal Shehu con dey beg parents say make den no dey allow dem pikin dey sell or waka for nyt sake of saymake den no go enta bad pipu hand. He con yan say five of the suspects be students of Nasarawa State University wey den age range be between 20 and 22 years. Den yan say na ontop rape nahin dem arrest the students.
No comments:
Post a Comment