Saturday, June 4, 2016

AS E DEY HOT : DEM SAY PRESIDENT MUHAMMADU BUHARI DEY SICK OOO

Tori wey ddey enta we tamak from Aso rock dey yan us say we presido  Muhammadu buhari get one kind infection for hin left ear, wey den dey call Meniere Disease, den say dis wan nko nahin make we presido no too dey waka up and down for like one week now plus say Sai Baba don dey recieve treatment for inside Aso Rock. Tori yan say dis infection dey always make Baba complain of big big pain plus say Baba no dey hear wella plus say E dey always hear some kind sound, naso pipu dem wey close to Aso Rock yan us. Dem yan say Baba don cancel abroad waka like three times now wey be say na Junoir Baba V.P Osinbajo rep am for the place.
A gist wey Baba hinsef yan be say na we Vp go rep am for the 48th Ordinary Summit of Head of State plus Government of the Economic Community of West African States (ECOWAS) wey go shele for dis weekend for Dakar Senegal.

No comments: