Sunday, June 5, 2016

I NO DEY LET MY PIKIN MEET MY FRIENDS WEY BE MEN O...WAJE



Miss Simplicity - Aituaje Iruobe wey we all knw ad Waje don com yarn us y she no dey let any of her male frds near her pikin nd y she no dey too carry d pikin go show oooo.
Waje wey get 17-year-old pikin tell Genevieve magazine sey she no want make her pikin grow up dey think sey he dey gud make different different men dey enta nd go out of her house o nd sey even d guys wey she don date, she bin dey always tell dem sey dem must not come her house o. Waje tok sey since afta her pikin papa, na only one man she don introduce give her pikin o nd sey she knw sey d girl go like dey see sum body as papa, so she dey always allow d girl go stay wit her pastor nd him family make she for dey understand wetin family be o...Wow!! Na dis one I call beta mama, I wish sey many single mothers go fit learn from dis o..If u dey introduce different men as papa to ur girl pikin, abeg make una stop ham now o, e go affect d pikin lata oooo. Keep it up ma'am Waje...(see more pinshures afta the cut) 



No comments: