Edo State Governor, Adams Oshiomhole, plus hin Katsina State counterpart, Governor Aminu Masari, don condem the recent gboa gboa of oil pipelines by militants for Niger Delta region. Dem yan dis one for the time wey dem dey gist with State House correspondents shortly after one meeting wey dem do with President Muhammadu Buhari for the Presidential Villa, The two of den con yan say make wetin we suppose give we presido na support. Dem yan say wetin dey shelle no go make pipu wey wan invest con dar side. Dem com dey call evry evry wey dey dar side say make dem get patience for we presido sake of say as dem go take provide jobs give pipu na hin dey hin mind.

No comments:
Post a Comment