Friday, May 20, 2016

21-YEAR-OLD MAN DON COMMIT SUICIDE OOO BECAUSE WHY?

One Mr Tope Diya na hin don, committ suicide yesterday for hin place of work. wey dey Olayiwola Street, Oko Oba, Agege. Tori show say na about 7:00am yesterday a hin dem see am after
he don use  cloth hang himself from one aluminum frame wey dey hin working place. The spokesperson of the Lagos state police command, Dolapo Badmos, when E dey  confirm the matter, com yan as say dem neva sabi wetin make d man kill himself but shaoo the brother of the deceased nahin grin grin the matter to the police.

No comments: