The Chief Justice for the Federal Capital Territory, Justice Ishaq Bello don yan news men say den dey yan the pipu exactly wetin den dey see plus ear for court. E yan dis wan wen E dey folow journalists gist for one round table ontop Reporting Court Proceedings by the media for Abuja. E yan say if news men fit do dis nko e go make am dey easy for the pipu to trust den plus even the court sef. E con yan say judiciary plus journalists go work together sake of say this wan go make am dey easy for news men to get confam story bwacuse why dis one go make we country grow wella.

No comments:
Post a Comment