Miss Simplicity - Zayn Malik wey be 23yrs old singer nd Gigi wey be ogbonge 21yrs olld model naim don dey date each oda for over 7months o bt one correct source dey tok ham sey d relationship bin no get beta stand before base on sey na so so quarrel dem dey quarrel nd dem bin don breakup before dem com come back togeda before dis their major breakup o. D source wen e dey tell E News, e tok sey no be small mata as dem bin even fight for Gigi birthday party before dis breakup o.
So d source tok sey Gigi don last last blow d final whistle for d relationship o nd my pipu afta final whistle for football match, wetin remain again??? Match don finish be dat naw...na so e be for dis one o bt make we wait nd see.
Saturday, June 4, 2016
E WAN BE LIKE SEY FINAL WHISTLE DON BLOW FOR ZAYN MALIK ND GIGI HADID LOVE MATA OO
Subscribe to:
Post Comments (Atom)



No comments:
Post a Comment