One 30-year-old woman na him dem don carry go before Ikeja magistrates ' court sake of say she flog her landlord wey dey sick. The woman, Kike Adelaja wey dey stay for Ola Omotoye Street for Aboru, na him take beating decorate her landlord wey go challo am say dem dey smoke igbo for inside hin house. Police wey carry am come court, Clement Okuoimose, yarn the court say the woman give her landlord wey dey sick, Mr. Samuel Adebayo blow for face on May 12,cime give am injury. Police say the woman carry some bad guys come do igbo smoking carnival foe her house "The accused, na him the Papa landlord go challo dem. But the woman, Adebayo say na lie O she no dey guilty. So
magistrate, Mrs B. O. Okunsanya, wey siddon on top the mata give am bail for N10,000 plus one surety for same money come push the mata go July 11.

Wednesday, June 15, 2016
PEKELE PEKELE... WOMAN FLOG HER LANDLORD WEY DEY SICK ON TOP WETIN?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment