Saturday, June 4, 2016

AS E DEY HOT: RONKE GIWA DON COMMOT FROM MARKET

Hmmmm..... For those of una wey still dey dream say one day una go hayaj one of the most popular voices for Radio in Ibadan, Ronke Giwa, wey everybody sabi as Ronny G, the tori for una be say una don carry last. Simply bcos one sharp Bros don carry am commot from market, put ring for her hand and change her surname for her. Dem still dey there now dey go reception, so if you dey Lagos you still fit trace dem. No worry, we go sama una correct pinshures as we dey get am. We for TPN say congratulobia to we dear radio girl and her new family.

No comments: