Saturday, June 4, 2016

(FOTO)VANGUARD ALLURE MAGAZINE DON BRING FOUR ACTRESS OUT AGAIN O...WHO DEM BE??

Miss Simplicity - For d new edition of d magazine wey Vanguard Allure bring come out, dem sama us wit four ogbonge actress wey e be sey dem work for Nollywood make sense wella, dem be women wey e be sey dem take their career serious like sey tomorrow no dey o, dem dey always show passion, love, and drive for d their work o...
D four women na Linda Ejiofor, Omoni Oboli, Adesua Etomi nd Chioma Onyenwe nd for d magazine, d women tok abt their careers nd many oda tins o.
Na Ahamlbeleme naim do d Photography, RhodaEbun for Roses and Thorns I Tomiwa (AyabaCreations) naim be d Stylist o, Tj (HairCraft) naim do their Hair, Evelyn and Joanne(ZaronCosmestics) naim do their Makeup nd na Nelly Mesik(nellymesik) naim be d Creative Director o.
Na dis one naim I dey call " Beautiful" all d pinshures make sense.
See d pinshure dem afta d cut...

No comments: