Thursday, May 26, 2016

WIKE DEY PARA FOR NIGERIAN PORTS AUTHORITY AS DEM NO GREE PAY FOR INDUSTRY ROAD

Rivers State Governor, Chief Nyesom Wike, on Wednesday don dey para say he go carry management for Nigerian Ports Authority go court sake of say dem no gree drop money for the  N303m road repair wey dem dey do for the state. Wike still swear say the only thing wey fit stop am na if dem roger am wetin dem suppose do sharp sharp. Tori yarn us say when the governor enter office, only him don Waka go meet dem for NPA, plus some other agencies say make dem do normal for the state O, make dem join body help government gather money to dey maintain industry road wey don spoil. We hear say other companies for the area don do normal but NPA come dey do strong head, as per say dem no drop. When Wike come dey open the Industry Road wey dem dey call NPA Road before to take celebrate his one year for office, na there he remember say NPA Neva pay dem own money wey dem take re-arrange the road, he say as dem no pay so na like say dem dem do bad Belle for him government and dem wan make he fail.

No comments: