Thursday, May 26, 2016

DICKSON SAY NIGER DELTA AVENGERS JUST DEY PURSUE PIPU WEY FOR LIKE DO BUSINESS FOR NIGER DELTA

The Governor for Bayelsa State, Seriake Dickson, don dey halla say wetin new militant group, Niger Delta Avengers, sey do no go make sense for dem area O,  COS pipu wey suppose carry come do business go dey run away from the area. Na so dem say Dickson yarn for one statement on Wednesday, when him media padi, Daniel Iworiso-Markson, dey read for am, he dey yarn dat for one meeting wey he do with pipu wey come represent some international oil companies plus security chiefos. The governor come dey beg make everybody gather body stop dis yeye thing wey dey kpain security pipu, innocent citizens, still dey scatter oil companies property wey dem  Niger Delta Avengers dey do.
He say all the pipu wey dey do dis bad things na criminal and dem no wan make the country progress, COS all this gbege wey dem dey drag dey pursue beta pipu wey for like carry dem money come do business for the area plus including the international community.

No comments: