NLC don stop dem strike wey dem take dey fight government sake of saying increase petrol money from N86.50k to N145. Dem decide to stop am for one kain emergency meeting wey dem National Ogas do for Abuja on Sunday. Dey still gree say dem go continue yarnings government on top wetin dem go fit do for electricity money wey dem increase by 45% plus petrol money too. NLC presido, Mr. Ayuba Wabba, women read wetin dem agree to news pipu for Abuja on Sunday no talk talk date gangan wey dem go meet, yarn with government. The statement wey he gather hand sign with dem General Secretary, Dr. Peter Ozo-Eson, no talk wen dem go start negotiation. Wabba just say dem gats bone the strike cos some emails pikin wey get mouth wella don beg dem, especially dem Ogas for APC, Asiwaju Bola Tinubu plus others. The NLC Presido yarn journalists say e no dey posibu NLC carry face for all those pipu wey dey beg dem, make we no reason say na wetin Minister of Labour and Employment, Dr. Cris Ngige talk say government no go follow dem yarn until dem stop strike make dem stop am true true.
No comments:
Post a Comment