Monday, May 9, 2016

TIWA SAVAGE DON SHOW BACK AGAIN FOR SOCIAL MEDIA... SEE WETIN SHE FIRST DO



No mata wetin happen,  life gats to continue ni. Na him make Tiwatope Savage, Mama Jamil show back for social media afta she do that 45 minutes interview wey reign last week like gala for express. Tiwa don return to work K,  dem first see her dey shoot music video, afta dat dem see her for location where dem dey shoot Jennifer's diary and now she don gather mind come on top social media and na thank you messages she take enter. Oya see as she talk am for inside the pinshure. Uwc sister.



No comments: