8 out of the 12 former members for National Working Committee for PDP don talk say dem gree for the result wet commot from dem party national convention wey shele for Port Harcourt, Rivers State, wey scatter dem own committee. Na dat one make say the former NWC members don commot from the back of Ali Modu Sheriff, wey still dey argue say na him be dem Oga for the party. Some pipu like the National Secretary, Prof. Wale Oladipo and the National Auditor, Alhaji Fatai Adeyanju still dey follow SHERIF do strong head say na dem be the national officers for the PDP. In fact dem still dey court dey drag the mata. The 8 pipu wey don gree for one statement wey dem gather hand sign say dem don gree to support the party national caretaker committee wey former Governor for Kaduna State, Ahmed Makarfi, dey siddon on top. Dem be the former Deputy National Chairmo, Prince Uche Secondus; the Deputy National Secretary, Mr. Onwe Solomon Onwe; the National Legal Adviser, Mr. Victor Kwon; and the National Woman Leader, Dr. Kema Chikwe plus other national officers. Dem even say dem National Publicity Secretary, Chief Olisa Metuh, wey no well at the time follow dem gree. But sha O, nobody sabi wetin make the National Organising Secretary, Alhaji Mustapha Abubakar no sign the statement.

No comments:
Post a Comment