Thursday, May 26, 2016

ARSENAL NO WAN FREE OUR PIKIN, ALEX IWOBI MAKE HE PLAY FOR US O

Arsenal wan show demself for us O,  as e be like say dem no wan allow Alex Iwobi make he play for us for from Olympics wey go soon start. Earlier for dis month na him  Dream Team V1 coach  Samson Siasia don travel go London go yarn with him players and dem club as per say make dem gree release dem for the tournament. Arsene Wenger talk am for April say he go allow Iwobi  join up with him country, even Dat one go mean say the 20 year old guy go miss beginning for next season.  But Siasia say e be like say Arsenal don dey reason am to change am for us O, as e be like say dem no wan free our pikin again. ARSENAL no do anyhow oooo.

No comments: