Thursday, May 26, 2016

HOUSE MEMBERS VEX AS ARASE, ORTOM AND DAMBAZZAU NO SHOW FOR AGATU MEETING WEY DEM CALL

Members of we House of Reps vex gan on Wednesday as Pipu wey get mouth for Benue no gree show face for the meeting wey dem wan do take shine light on top the killing wey shele for Benue State by pipu wey dem suspect say dem be Fulani malu pipu for Agatu villages. Na like 500 villagers we hear say the bad pipu chuke die for Agatu in March. Dem still come put fire for plenty houses, wey make say like 7,000 pipu no get house again. That kain hayaj don still shele for Buruku, Gwer-West/East, Makurdi plus other local government areas for the state, wey plenty pipu follow am Waka. We House of Rep pipu don say wetin dey cause dis gbege na how plenty had malu pipu dey enter Benue state anyhow, dey hayaj dem and na wetin dem bin wan shine light on top be that. The House Committees for Police, Defence plus National Security don open  public meeting on top the hayaj on Wednesday, but dem shock as dem no see the Oga patapata, the Inspector-General of Police, Mr. Solomon Arase, Oga Minister for Interior, Lt-Gen. Abdulrahman Dambazzau (retd.), plus the Governor for Benue State, Mr. Samuel Ortom, na all of dem no show and thing make committee members vex well. Tori say no government official na him send person to even go represent am  for the meeting. As dem no show the committee gats push the meeting go anoda day after dem hear from some groups like Mdzough U Tiv.

No comments: