Wednesday, April 20, 2016

MAN TALK, WOMAN TALK DON READY TO BREAK ANODA RECORD FOR IBADAN LAND

Yes O, shebi Ibadan na home for many first things for Naija. Ibadan don still do am again O,  as dem dey set new record for the history of Live Theatre Productions for Naija, Another Stage Play in IBADAN #ASPII wey go shele under the aburada of Raindrops Entertainment don ready to do anoda thing wey Neva happen before for Naija. And wetin dem wan do na to first show dem play,  wey be the funny play wey Olarotimi write wey him name na MAN TALK WOMAN TALK ...battle of the sexes. The premiere as Oyinbo dey call am na STRICTLY BY INVITATION for pipu wey be press, media pipu , OAPs, bloggers and pipu wey get mouth for Entertainment for Ibadan land.  Those pipu go see am, come tell dem wetin dem fit for to make am beta before the full world come watch am on May 2nd 2016 for Arts Theatre, wey dey University of Ibadan. Tori yarn us say the play go funny die,  but if you sabi Mr Rain wella, wey him real name na Babatunde Ojobaro wey dey produce am,  you go sabi say the thing go funny die.

No comments: