Thursday, September 24, 2015

KERE O! DEM DON START EMPIRE SEASON 2 O...**DANCING SHOKI**

If you never know, make you know now o, say the film wey dey totori me pass for now don start again o. After dem do first season finish, na so dem go end the film for one bad corner wey make persin dey hungry for more. Dem carry my own Lucious go prison...see, if you never watch the film, no be me go tell you. But the koko of the tori be say dem don start Season 2 for FOX, but dem dey download am online for free. You say where the link? shey pipusnews be like g for your eye?

No comments: