I no fit shout o, but today I go shout take hail Baba God because today i chop anoda year and incase una wan sabi how many Christmas I don chop, na dis year go make am 28 years wey me sef don dey dis life, so I no be small pikin like dat. As I dey celebrate today na so plenty other beta pipu dey do am today, pipu like Tunde Adedokun for Space Fm 90.1, Master Akorede (The little Prince of Haleesha), Dakore Akande wey dey do film, Alaafin of Oyo Oba Lamidi Adeyemi, Late Fela Anikulapo Kuti ati be be lo. I pray make baba God sama us beta gift for our byday today and forever.
No comments:
Post a Comment