17-year-old house girl , Rhoda, wey say her Lebanese Oga we be cook for one popular hotel for Lagos, Hassan Ali Husseini, rape am her when she dey work for am don born. The girl wey dey NAPTIP dommot born for hospital wey dey Police College, Ikeja. Tori yarn us say the baby wey be girl, just be like carbon copy of Oga Husseini. Make we no forget say Husseini deny finish say na lie he no rape Rhoda, say na both of dem gree to chop yam together. Before tori yarn us say NAPTIP Zonal Commander, Mr. Joseph Famakin, don talk say Husseini don ready to collect the pikin of the pikin look like am as gift wey Papa God dash am. He still say no be NAPTIP work to carry the guy go court say na police things. But if the baby black like her mama, dem go do DNA. But Alleluyah, na Papa the pikin resemble, like say na original photocopy.

Saturday, May 21, 2016
PEKELE PEKELE... 17 YEARS OLD HOUSE GIRL WEY HER LEBANESE OGA RAPE DON BORN
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment