Saturday, May 21, 2016

FASHOLA SAY MAKE WE DEY TAKE CLIMATE CHANGE MATA PERSONAL O

Minister for Power, Works and Housing, Mr. Babatunde Fashola, don ask Naija pipu to take climate change mata seriously o. Fashola a come still  suggest how we fit take solve the mata when he dey yarn on top "Urban design and climate change" for the first Nigeria Urban Design Forum wey shele on Thursday. Na one former Lagos State Commissioner for Town Planning and Urban Development, Mr. Toyin Ayinde na him arrange the forum.  Fashola say evidence don show say dis climate change thing no be play play O,  as everybody don see wetin e fit cause, especially for human being body.

No comments: