LWKMD... Before before PDP governors plus ministers wey don do before on Friday no gree collect the plane wey dem National chairmo wey dem no like, Senator Ali Modu Sheriff, send make e go carry all of dem come Port Harcourt, Rivers State from Abuja. Tori yarn us say SHERIF plane to dem sake of say he wan scatter the second national convention wey the pipu wey dey vex dey arrange for Abuja today. The members wey dey vex for Sherif wey dey under aburada of Concerned PDP Stakeholders, dey do dem convention today for Area 11, Abuja, same day wey Sheriff group dey do dem own for PH. Tori yarn us say Sheriff group no bin dey reason dem but when dem see how dem dey ginger for the convention, fear begin dey catch dem. Dem say na for like 3 hours dem take delay the plane for Abuja, before dem late clear dem doubt day dem no dey go anywhere. SEE kasala for pipu wey suppose dey do opposition O.
No comments:
Post a Comment