Shebi if una hear Ibadan before, na dis first pinshure dey always dey for una mind, but Dat one don turn old school now o, COS one beta foto man, don snap Ibadan new pinshure and na the new pinshure be the main thing now. Na only God Sabi the person wey snap dis pinshure but the pinshure for dey break the Internet cos e just dey circulate everywhere. The pinshure na him dem take for night and na Challenge round-about dem for take am. Walahitalahi I think person wey take am suppose collect award. I believe na something like dis state government suppose dey encourage cos na dis pinshures we go take sell Ibadan O. SEE for yourself below na....


No comments:
Post a Comment