Pipu wey dey use road plus youths go block Igando side for Lagos State University-Iyana Iba Road on Monday on top how policewoman kpain one to danfo driver, Muyiwa Ijaduola. Dem burn tyres and pako around dat kain 11am, carry 3 buses block the road, say make dem police Ogas catch the police woman, Taiwo, wey do the bad thing and make dem carry Ijaduola dead body give him family. Tori yarn us say on Sunday around 2.30pm, Taiwo plus another female corporal dey front of one NNPC filling station for Igando area, dey check vehicles. We hear say dem stop 46-year-old Ijaduola, say make he Roger dem 5h. Na for where dem dey argue, dey drag, police woman push Ijaduola inside gutter, na so he carry head nack edge of the gutter. Tori say as the woman see wetin she don do, na so she clear before other pipu come gather say make dem come help the guy stand up, na when dem reach him side dem see say he don kpain. Youths for the area wey dey vex, come go station for Iran do around 6.30pm, but na gun dem take pursue dem and police carry the deadbody go mortuary. Hmmm.... Make God sha dey save us for dis country O..... Abeg make dem find the yeye policewoman come out O.
No comments:
Post a Comment