Wednesday, May 18, 2016

OH BOY EH!... SEE HOUSE WEY KUNLE AFOLAYAN JUST BUILD



We beta pikin wey dey do beta film, Kunle Afolayan don sama us anoda correct video, calm down no be CEO, dis one na Kinging and na him he take show us him tear rubber house. The one minute video na him take show us him mansion, come still put one kain personal message for there. He say the video no be to bragado but to let dem sabi say to work hard na beta thing and nothing wey you dey dream wey you no fit achieve. He say but first O, him reason na to Thank GOD say he don give am opportunity to realize him dream. Oya you sef see for yourself the pinshure wey be say na that camera wey dey fly like plane, wey Oyinbo dey call drone, dem take snap am.




No comments: