Wednesday, May 18, 2016

ALUTA... CONTINUA ASSOCIATION OF IBADAN ENTERTAINNENT STAKEHOKDERS WAN MEET DIS MORNING

Still on the yeye mata of event license abi na permit dem call am. Association of Ibadan Entertainment Stakeholders for OYO State don gree to meet dis morning by 10 a.m for GQ lounge wey dey Bodija, dat one na as we still dey wait for statement wey Oyo State Government say dem go throway today. So for everybody wey get interest abi wey dey do anything wey take style relate to entertainment for Naija, make dem show face for the meeting.

No comments: