Thursday, May 26, 2016

OBIANO BOYS BURST KASALA FOR MARKET, FLOG WOMEN LIKE GOAT

Plenty market women for Ogbaru Market wey dey Anambra State, na hin dem hayaj on Wednesday by one kain government agency, Ocha Brigade wey pipu Sabi wella as Governor Obiano Police. Tori yarn us say many of dem woundjure and na rush dem rush dem go hospital wey dem no talk hin name for Ogbaru. Gbege shele when the state pipu wey one Kenneth Okonkwo carry come  , enter the market begin shoot, wey make market pipu take off. Tori yarn us say dem pafuka many things wey pipu dey sell like plantains, water melon, tomatoes, vegetable etc. The talk tall person for the market pipu, Charles Orji, say dem be like 300 Ocha Brigade pipu wey show for dem market, he say na for phone dem halla am say kasala don burst O and na when he reach there he see see
Okonkwo, the Oga and him goons dey do pipu strong thing, dey shoot anyhow, he say the thing be like war. He say dem just dey flog women like say dem be animal. One of the women wey woundjure, Mrs. Chinyere Okafor, wey be 35-year-old mama of 5 pikin yarn journalists say ma her N45,000 money and her market follow the mata Waka.

No comments: