Tuesday, May 24, 2016

NIGERIA GO BEGIN PRODUCE AVIATION FUEL SOON.... NICE

Sake of say we gas reduce the cost of aviation fuel, Nigeria go soon begin fuel production, Minister of State for Aviation Senator Hadid Sirika nahin yan dis one. He con still dey yan say. the production so  nahin go regularise the supply plus lead to reduce air moni. Sirika, wey yan dis one for one stakeholders' forum inside Abuja, tok say the government don approve duty waivers' for importation of aircraft plus spares sake of say dem go fit ensure the survival of domestic airlines. He tok say we government, dey work on one aviation masterplan. this one so go dey incorporated into the National Integrated Infrastructure Master Plan (NIIMP).

No comments: